BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Wetin go happun next as Inec publish details of political party candidates for 2027 elections
Dis publication dey open to di public to check di kain qualifications and oda credentials wey di candidates submit to Inec for di 2027 election.
'We refuse to negotiate, We no gree pay ransom' - Tinubu ontop Oyo school children and teachers rescue operations
Dis na di first time di President go publicly address how govment take secure di release of di school children and teachers wey jaguda pipo kidnap for di state.
'Wen you grow up, I go marry you' - Who be di Ghana lawmaker wey 'sexualise' young schoolgirl
Human Rights groups and oda citizens say di behaviour of di lawmaker dey unacceptable.
Burial director wey no gree bury deadibody chop 20 years prison sentence
Robert Bush no also cremate pipo and im bin give di families and relatives di ashes of strangers.
Hamas say dem don agree to disarm afta Trump announce Board of Peace plan
One senior Hamas official tell BBC say dem don agree to di Board of Peace plan. Israel neva comment.
'Heads suppose roll' - Nigerians react as Head of Service Didi Walson-Jack take responsibility
Di Head of di Nigeria Civil Service say her office take responsibility for not doing dia due dilligence bifor approving di 'fake agency' to take off.
US launch 'heavy' strikes on Iran afta attempted attack on American sojas
Afta a short period of relative calm wen dem pause di fight, both sides don start again wit missile attacks.
Nigerian Army appoint General Officers Commanding for new Army divisions
Nigeria Chief of Army Staff (COAS), Lieutenant General Waidi Shaibu don approve di appointment of General Officers Commanding (GOCs) to di newly established Army Divisions
South Africa govment to prosecute citizens wey cause kasala during anti-migrant protests
Tok-tok pesin for South Africa Department of International Relations and Cooperation tok say govment dey willing to prosecute citizens wey act unlawfully.
Special Tori
Ghanaians, Zimbabweans among 127 foreigners arrested as South Africa Home Affairs set to deport illegal immigrants
Dis na part of di new operation wey di South Africa police carry out as part of dia efforts to curb illegal immigration.
Wat next afta Ghana accept proposal to extend presidential term limit from four to five years and oda constitutional review proposals?
Ghana plan to organise referendum for 2027 to change presidential term limit from four years to five years.
Dem fit join back man gbola afta dem don cut am?
"For some cases, e possible to join back person penis or reconnect penis wey don cut, but e depend on di type of injury and how quick di person get medical treatment," Dr Jibrilla tok.
'Nigerian nationals don lose dia life, South Africa dey use xenophobia as distraction' - Wetin Nigeria and Ghana tok so far
Di Foreign minister Ablakwa tell di BBC say South Africa no dey do enough to stop attacks on foreigners.
Ghana Appeal Court free ex-govment official Sedina Tamakloe wey di US extradite to serve her 10-year jail term for corruption and stealing
Ghana Appeal Court decision to acquit and discharge ex-govment official Sedina Tamakloe afta she return to serve her 10-year jail term for corruption and stealing, dey cause kasala.
US court jail Ghanaian businessman Derrick Yeboah for seven years ova $10m romance scam
Derrick Van Yeboah be di latest Ghanaian wey dem sentence for di US ova romance scam, di court go deliver verdict for anoda businessman 'Dada Joe Remix' on 28 September 2026.
Front line of Ecuador drugs war wia police dey fight gangs, guns and corruption
Di BBC go on patrol wit Ecuador police, wey dey battle huge increase in drug crime.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.












































